Abia State governor suspend Chief of Staff for spraying money on Odumeje

Wed, Dec 9, 2020
By editor
1 MIN READ

Politics

ABIA State Governor, Dr Okezie Ikpeazu, don suspend im Chief of Staff, ACB Agbazuere from office.

Secretary to di State Government, Barrister Chris Ezem announce dis one on Sunday inside statement.

“Abia State Governor, Dr Okezie Ikpeazu, don direct di immediate suspension from office of di Chief of Staff to di Governor, Dr Anthony Agbazuere,” na so di statement read.

E add say Agbazuere suspension na wit immediate effect.

Although dem no mention why, di Chief of Staff bin appear for inside video wia e dey spray one popular Prophet Chukwuemeka Odumeje aka Indaboski for e office.

Skip Instagram post, 1

End of Instagram post, 1

Di date wey dem shoot di video no dey known.

But di governor say make di Permanent Secretary of di state goment house, Alozie Odoemelam begin perform di duties of di Chief of Staff.

 

BBC Africa

– Dec. 7, 2020 @ 18:16 GMT |

Tags: